Saturday 23 March 2013

Tu face idibia marry anne macaulay









Tu baba finally marry anne today. see photo of wetin happen as many celeb show for dubai for the ceremony. Some of the celeb wey show na Basket mouth, Davido, Banky w, Ini edo, Don jazzy, Kate henshaw, Eldee, Dr sid, Chidi mokeme,Susan peters,Rita dominic,Mike ezeruonye and so on

NIGERIA 1-1 KENYA

Naija super eagles play draw with Kenya for u.j esuene stadium for calabar. Kenya first score for 36mins from F.Kahata before Nigeria equalize for 90mins from Odumadi. At least the cause wey dem they cause themselves for twitter go stop.

PASTOR WIFE WEY BE PROPHETESS CARRY HUSBAND GO COURT FOR ADULTERY

Titilayo Oluokun, one prophetess, go beg for Court to settle her 22-year-old marriage. The 51-year-old woman, wey dey live for 8, Aina Aladi Street, Agbado, Lagos, tell court say her husband, a pastor, don get four children from four women for just three years.
She talk say she don give one of the women N20,000 so that they no go dey disturb for church.when she come know about the remaining two women na when she decide to go court.

”To my surprise, he impregnated two women after. That was when I knew I had to call it quits with him. ”I had him arrested sometime last year because he wanted to stab me and, from the police station, he was asked to move his things out of my house” na so she talk am.
titilayo talk say na she even get the house wey them dey stay but him go dey waste money on top other girls

The wife wan settle the marriage carry the pikin them,but her husband Adewale neva come court for the third time now.the court oga don push the case go April 3.